45
God Propaty
“Wen dem don divide di land kon give all di tribes for Israel dia share, dem go dedikate one part give God. E go almost long rish nine mile kon wide pass three mile. All dis aria go dey holy. For dis aria, one skware go bi for di temple and na eight hundred and seventy-five fit for each side and e go get space wey wide rish eighty seven and half fit. Half of dis aria go almost rish nine mile kon wide pass three mile; di temple wey bi di Holy Place, go dey inside. E go bi di holy part for di kountry and na di priests go enter inside go serve God for en temple. Dia house go dey inside di kompond and my temple go dey der too. Di oda half for di aria go bi Levi pipol own. Di pipol wey dey do di work for di temple and town, go get where dem go stay for der too. Near di Holy Place, anoda place wey almost long rish three mile and wide rish eight and five mile, go dey for Israel pipol to stay too.
Di Prince Land
“Land go dey for di prince wey dey rule. E go get from di boundary for west for di holy aria go rish Mediterranean Sea and from di boundary for east go rish di east borda for di kountry and di lengt go bi di same with di one of di land wey dem give Israel tribe. Dis aria go bi di prince wey dey rule Israel own, so e nor go opress di pipol again and di remainin part for Israel go bi di tribes own.”
Law For Di Prince
God wey get pawa sey, “Una wey bi ruler for Israel, na since una dey sin! Make una stop una wahala and opreshon. Make una dey do di rite tin. Una nor go ever drive my pipol komot from dia land again. Na mi wey bi Oga una God dey tok so. 10 Evribody must measure well So from naw go, make evribody dey measure well. 11 Di basket wey dem dey use measure dry tins, must dey ekwol with di one wey dem take dey measure wota and na di normal size una go use. Di result for di measurement na: one size must ekwol ten basket and ten baskets must ekwol one bag. 12 Na so una weigh suppose bi: twenty gerahs must ekwol one shekel and sixty shekels must ekwol one mina.
13 “Dis na how yu go take give yor ofrins: Wheat: go bi one for evry six wey yu harvest, Barley: go bi one for evry six wey yu harvest, 14 Olive oil go bi one for evry ten wey yu produce from yor trees. (Den make yu measure am with di bottol: 10 bottol na one normal size and e must ekwol one gallon.) 15 Sheep go bi one out of evry two hundred wey dey Israel. Una go bring rice ofrin, animal wey dem go burn and animal for di fellowship ofrin, so dat I go forgive una sins. Mi God wey get pawa don kommand. 16 All di pipol for di land go take dis ofrin go give di prince wey dey rule Israel naw. 17 Na en work to bring di animal wey dem go burn, di korn ofrin for di New Moon Festival, di Sabat Day and di oda festivals. Na en go provide di ofrin for sins; di korn ofrins, di full animal wey dem go burn as ofrin and di fellowship ofrin, so dat God go forgive Israel pipol dia sins.”
Di Festival
18 God wey get pawa sey, “For di first day for di first mont, yu go sakrifice one melu wey dey okay kon klean di temple. 19 Di prince go take some of di blood kon put am for di four korna for di altar door-mot and di door-mot wey dem dey pass enter di main kourt. 20 For di sevent day for di mont, yu go do di same tin for di pipol wey sin and dem nor know sey dem sin. Like dis, yu dey make di temple dey holy.
21 “For di fourteent day for di first mont, yu go start to celebrate di Passova Feast. For seven days, evribody go chop bread wey nor get yist. 22 For di first day wey di festival start, di prince wey dey rule go offa one melu as sakrifice for en sins and for di pipol sins. 23 For each of di seven days for di festival, e go sakrifice seven ram wey dey okay kon burn dem give God. Evriday, e go still sakrifice one goat as ofrin for sins. 24 For evry melu and ram wey e go sakrifice, half bag of rice and three kwota of olive oil, must dey as ofrin. 25 For di Festival wey go start for di Fifteent day for di seven mont, di prince go offa di same sakrifice for sin for dat seven days. E go burn di same ofrin kon give di same korn and olive oil.”