21
How To Trit Slave
“Naw, dis na di laws wey yu go tell Israel pipol:
Hibru Savants
“If una buy any Hibru slave, e go serve una for six years, but e go dey free for di sevent year and e nor go pay anytin. If di slave neva marry before e kom, na only en go komot, but if e don marry before e kom, di slave go komot with en wife.
“If na en oga gi-am wife and en wife born shidren, den na en oga go get di wife and di shidren, so na only di slave go-go. But if di slave sey, ‘I love my oga, my wife and shidren; I nor go-go,’ den di oga go take am go meet doz wey dey judge. Dem go bring am kom di town gate kon put hole for di slave ear and di slave go serve en oga forever.
“If anybody sell en dota as slave, di girl nor go-go like man slave. If di girl nor make belle sweet en oga wey buy am, den di oga go let am go. E nor get rite to sell am give strenjas, bikos na di oga break di kontract with am. If e give di slave to en son as wife, e go trit di slave like en own dota. 10 If di man kon marry anoda wife, e must kontinue to give en first wife food, klot and evritin wey e nid as wife. 11 And if e nor fit give di girl dis three tins, e must free am and di girl nor go pay anytin.”
Law About Yeye Karata
12 “Anybody wey nak and kill anoda pesin, dat pesin must die too. 13 But if na by mistake, den e go eskape go di place where I go choose and e go dey save for der. 14 Like dis too, if anybody use wayo take kill en neighbour, den una go take am komot from my altar go kill.
15 “Anybody wey beat en papa or mama, dem must surely kill-am.
16 “Anybody wey kidnap and sell pesin or dem katch di pesin for en hand, dem must kill-am.
17 “Anybody wey do or trit en papa or mama anyhow, dem must kill-am.
18 “If two pipol fight and one among dem nak en sekond with stone or with en hand and e nor die, but e sick 19 and leta e kon stand up waka by ensef, den di pesin wey nak am, don dey innocent, but e go pay di pesin wey e wound all di time wey e don waste kon make sure sey en body strong.
20 “Anybody wey nak en savant, weda na man or woman savant with stik and e die, dem must ponish dat pesin. 21 But if di savant wey wound nor die afta one or two days, dem nor go ponish en owner, bikos e nor luz anytin.
22 “If two man dey fight and one mistakingly nak woman wey get belle and e kon born di pikin before nine monts, but e nor too wound, dem go ponish am akordin to wetin di woman husband ask for and e go pay anytin wey kourt sey make e pay. 23 But if di wound sirious and di woman kon die, den dem must kill who kill di woman and 24 na dat one bi eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg. 25 Who burn pesin, dem go burn am too. Who wound pesin, dem go wound am too and who beat pesin, dem go beat am too.
26 “If anybody blind en savant eye, di man must free di savant, bikos of di eye wey e blind. 27 And if di man nak en savant tit komot, e must let am go free, bikos of di tit wey komot.”
Law About Animal
28 “If pesin melu kill pesin, den dem go stone di melu die; nobody go chop di meat and dem nor go ponish di owner. 29 But if di melu dey always take en horn wound pipol and dem don warn di owner before and e nor do anytin koncerning di matter, before di melu kon kill pesin, dem must stone di melu die kon kill di owner too. 30 But if dem put prize for di owner head to save en life, den e go pay di full amount.
31 “If di melu take en horn wound pesin pikin, dem go judge am like di oda ones. 32 If di melu take en horn wound pesin savant, di owner must pay three shekel for silva and pipol go stone di melu die.
33 “If anybody dig pit for groun and e nor kover am and one melu or donkey fall enter, 34 di pesin wey get di pit must pay for di animal. E must pay to di owner, den di animal wey don die, go bi en own.
35 “If one man melu wound en neighbour melu and e die, den di two pipol go sell di melu wey dey alive kon share di money and dem go still share di melu wey die too. 36 Or if pipol know sey di melu dey always attack odas and dem tell di owner and e nor do anytin koncerning di matter, e must use di melu take pay, den di one wey don die, go bi en own.”