22
Law About Propaty
“If pesin tif one melu or sheep kon kill or sell am, e must use five kattle take pay for di melu and four sheep, for di sheep wey e sell or kill.
“If dem katch tif dey enter pesin house kon nak am die, en blood nor go dey anybody head.
“But if na for day time dem kill di tif, di tif blood go dey who kill-am head.
“Tif wey dem katch must pay evritin wey e tif. If e nor get anytin, den dem go sell am take pay for wetin e tif. If dem si wetin e tif for en hand; weda na melu, donkey or sheep and di animal neva die, di tif must pay doubol.
“Anybody wey allow en animals wey dey chop grass for field go chop wetin anoda man plant for en farm, e must pay back with wetin good pass for en own farm.
“If fire dey burn for pesin farm kon spread and distroy plant for anoda pesin farm, di pesin wey start di fire go pay evritin wey distroy.
“If pesin give en neighbour money or propaty to keep for am and dem kon tif di tin for di man house, if dem katch di tif, e must pay doubol. But if dem nor katch di tif, den di owner of di house go-go stand make dem judge am, weda naim take en neighbour propaty.
“If two pipol dey drag propaty, weda na melu, donkey, sheep, dress or any kind tin wey lost, di two of dem go kom meet di judge and anybody wey dem sey dey guilty, go pay doubol.
10 “If pesin give en neighbour one donkey, melu, sheep or any oda animal to keep for am and e kon die, wound or pesin tif am and e nor know, 11 di neighbour must swear to God sey, e nor get hand for di matter and di owner go asept en word and e nor go pay anytin. 12 But if dem tif am from am, e must pay di owner back. 13 If na wiked animal kill-am, di man go bring di meat pieces wey skata for groun to show and klear ensef and e nor go pay anytin.
14 “If pesin borrow animal from en neighbour and e kon wound or die wen di owner nor dey with am, di man must pay back. 15 If di owner dey with am, di man nor go pay anytin, bikos wetin e pay take hire am kover di money.
Law About Relashonship
16 “If pesin deceive girl wey neva no man and e kon sleep with am, e must pay di bride prize kon marry di girl. 17 But if di girl papa nor gri gi-am to di man, di man must pay di prize wey dem dey pay for woman wey neva sleep with man before.
18 “Make una nor allow witch live.
19 “Anybody wey follow animal sleep, dem must kill-am.
20 “Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.
21 “Make una nor sofa or opress strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.
22 “Make una nor sofa wimen wey dia husband don die or shidren wey nor get papa and mama. 23 If una sofa dem and dem kry kom meet mi, I go listin to dem. 24 I go vex and kill una with swod and una wifes go turn who nor get husband again; una pikin nor go get papa too.
25 “If una borrow money give poor pipol wey dey among una, make una nor do like sey una borrow money and make una nor add join di money wen dem won pay back. 26 If una take una neighbour klot as shorti, una must return am gi-am for evening, 27 bikos dat na di only klot wey una neighbour get to wear, so dat kold nor go katch am. E get any oda klot wey e go take sleep? And wen e kry kon meet mi, I go listin to am, bikos I dey pity for pesin well-well.
28 “Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.
29 “Make una give mi una plant and wine ofrin.
“Una must give mi di first son wey una born.
30 “Una go still do like dis for una animals; dem fit dey with dia mama for seven days, but una go give dem to mi for di eight day.
31 “Una go bi my holy pipol, so make una nor chop any animal wey anoda animal kill for bush. Una must trow di animal meat give dogs.