8
Di Ashawo Woman
Den Jesus waka enter Mount Olives. For early morning, e enter di temple. Plenty pipol gada for der and e kon sidan dey tish dem. Di pipol wey sabi di law and di Farisee pipol kon bring one woman wey dem katch sey e sleep with man wey nor bi en husband. Dem kon make am stand for dia front, den dem tell Jesus, “Tisha, wi katch dis woman wen e dey sleep with one man wey nor bi en husband. Moses Law sey, ‘Make dem stone dis kind woman die.’ Wetin yu get to tok for dis matter?” (Dem ask am dis kweshon to set trap for am, make dem for fit katch am).
But Jesus bend down kon take en finger dey rite sometin for groun. Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.” E kon bend down again bigin rite for groun.
Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front. 10 Den Jesus stand up ask am, “Madam, where di pipol wey bring yu? Nobody remain to kondemn yu?”
11 Di woman ansa, “Oga God, nobody remain.”
Den Jesus tell am, “Mi too nor go kondemn yu. But from naw go, make yu nor sin again.”
Na Jesus Bi Di Lite Wey Dey Di World
12 Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”
13 Di Farisee pipol kon dey argue with am sey, “Yu dey tok about yorsef and wetin yu tok, nor bi true.”
14 Jesus ansa dem, “Even if I dey tok about mysef, wetin I dey tok na true, bikos I know where I from kom and where I dey go. But una nor know where I from kom or where I dey go. 15 Una dey judge pesin with wetin una si with una eye, but I nor dey judge pipol like dat. 16 But, if I sey pesin do bad, di tins wey I si and tok about, na true, as e bi sey nor bi only mi dey tok am. Na mi and my Papa wey send mi, dey tok am togeda. 17 God word sey, ‘Wetin two pipol bear witness about, na true.’ 18 I dey bear witness about mysef and my Papa wey send mi, dey bear witness about mi too.”
19 Dem kon bigin kweshon am, “Who bi yor Papa sef?”
Jesus ansa dem, “Una nor know mi or my Papa, if to sey una know mi, una for know my Papa too.” 20 Jesus dey tok to dem near di box where dem dey put ofrin money, wey dey inside di temple. Nobody fit katch am, bikos en time neva rish.
Where Jesus From Kom And Where E Dey Go
21 Den Jesus kon tell dem again, “I dey go and una go look for mi, but una go die inside una sin. Where I dey go, una nor go fit kom der.”
22 So di Jew oga dem kon dey ask, “Abi e won go kill ensef? As e dey tok sey, ‘Where I dey go, una nor go fit kom der?’ ”
23 Jesus ansa dem, “Na groun una from kom, but mi, na heaven I from kom. Una kom from dis world, but I nor kom from dis world. 24 Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”
25 Den dem ask am, “Who yu bi sef?”
Jesus ansa, “Na wetin I tell una from di biginnin. 26 I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”
27 (But dem nor undastand sey e dey tok about en Papa for heaven). 28 Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi. 29 And di Pesin wey send mi dey with mi. E nor dey leave mi, bikos I always dey do di tins wey E wont.” 30 As e dey tok, many pipol kon bilive am.
Abraham Pikin And Devil Shidren
31 Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples 32 and una go know di trut and di trut go free una.”
33 Dem tell am, “All of us na Abraham pikin, wi neva bi slave to anybody before. Why yu dey sey, wi go dey free?”
34 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una, anybody wey dey kommit sin, na sin bi di masta wey dey rule am. 35 Pesin wey bi slave nor dey stay for inside dat family forever, but pesin wey bi pikin for di family, naim dey stay forever. 36 So wen Man Pikin free una, una don dey free bi dat. 37 I know sey una kom from Abraham family, but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok. 38 Na wetin I si wen I dey with my Papa, naim I dey tell una, so make una dey do di tins wey una hear from my Papa.”
39 Dem tell am, “Na Abraham bi awa papa.”
Den Jesus ansa dem, “If una bi Abraham pikin, una for dey do di tins wey Abraham do. 40 But una won kill mi, bikos I tell una di real trut wey I hear from God. Abraham nor do wetin una dey do so o-o. 41 Una dey do di tins wey una papa do.”
Dem kon tell Jesus, “Awa papa nor born us for outside marriage. Na God ensef bi di papa wey wi get.”
42 Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi. 43 Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim make una nor fit undastand wetin I dey tok. 44 Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa. 45 Na bikos I dey tell una true word, naim make una nor gri bilive mi. 46 Who among una go fit show sey I kommit sin? Since I dey tell una true word, why una nor won bilive mi? 47 Di pesin wey bi God pikin, dey listin and do wetin dem rite for God word. Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word, bikos una nor bi God Pikin.”
48 So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”
49 Jesus kon tell dem, “I nor get demon. I dey respet my Papa, but una nor gri respet mi. 50 I nor wont make una praiz mi, but na God, di One wey dey heaven, na-im wi suppose praiz and E go judge evribody for di korrect way. 51 I dey tell una true word, if anybody follow wetin I dey tish, e nor go die again.”
52 Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’ 53 Yu big pass awa papa Abraham and all di profets wey don die? Who yu tink sey yu bi sef?”
54 Jesus ansa, “If I dey praiz mysef, my praiz na yeye one. Di pesin wey dey praiz mi na my Papa, wey una dey sey, ‘Na-im bi awa God.’ 55 Una nor know am, but I know am and if I sey I nor know am, I dey lie like una. I know am and I dey follow wetin e dey tok. 56 Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom. E si am and e happy well-well.”
57 Den di pipol ask am, “Yu neva old rish fifty years and yu sey yu don si Abraham?”
58 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!” 59 Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.