10
Jehu Kill Evribody For Ahab Family
Ahab get seventy sons for Samaria. So Jehu rite and send leta go give di sojas oga and doz wey dey guide Ahab shidren. Dis na wetin e rite for di leta: “Since, una oga sons, horse, fine towns and weapon, dey with una, wen dis leta rish una hand, make una pick one from una oga pikin wey fit fight kon make am king, so dat una go fit fight for una oga shidren.”
Dem fear well-well kon sey, “Si! If two kings nor fit stop yu! How wi won take stop yu?”
So di pesin wey dey look di palis, di leader for di town, di eldas and di guards kon send dis message go meet Jehu sey, “Wi bi yor savants! Wi go do anytin wey yu tok. Wi nor go fit crown anybody. Make yu just do wetin yu know sey dey good.”
Jehu rite anoda leta go give dem sey, “If una really dey my side and una ready to obey mi, den tumoro, make una karry una oga sons head kon meet mi for Jezrel.”
King Ahab born seventy sons and na doz wey dem respet well-well for di town, dey kare for di sons. Wen dem receive di leta, dem katch di king sons kon kill all of dem. Dem put dia heads for basket kon send am go meet Jehu for Jezrel. Di messenja kon tell Jehu, “Dem don bring di king sons head kom.”
Jehu ansa, “Make yu hang dem put for two stik for di town gate till tumoro morning.”
For morning, Jehu go stand near di head dem. Den e kon tell all di pipol, “I gri sey una nor do anytin, bikos na mi set trap for my oga di king kon kill-am. But na who kill all dis men? 10 So dis show sey evritin wey God tok about Ahab and en family, must happen. God don do wetin E tok thru en savant, Elijah.” 11 Den Jehu kill di odas for Ahab family wey dey Jezrel, plus all en ofisas, klose friends and priests. E nor leave any one.
12 Jehu leave der kon go Samaria. As e dey travel pass Bet-Eked (where doz wey dey guide sheep dey kamp put), 13 Jehu meet some pipol wey rilate to King Ahazaya for Judah. Jehu kon ask dem, “Who una bi?”
Dem ansa, “Wi bi King Ahazaya family membas. Wi dey go Jezrel go greet Kween Jezebel and di odas for di palis.”
14 Jehu kon sey, “Make una katch dem kom!” So dem katch dem and Jehu kill all of dem for Bet-Eked pit, (na forty-two dem bi).
15 Wen e komot from der, e meet Jehonadab, Rekab pikin wey dey find am since. Jehu greet am kon ask, “Yu get respet for mi, just as I get for yu?”
Jehonadab ansa, “Yes, I dey respet yu!” Jehu kon sey, “If na so, den shake mi.” So Jehonadab stresh en hand and Jehu kon karry am enter en horse. 16 Jehu kon tell am, “Follow mi, so dat yu go si how I dey sirious about God work.” So Jehu karry Jehonadab follow body.
17 E go Samaria kon kill all Ahab family wey remain, just as God don tok thru Elijah.
Jehu Kill All Di Juju Profets
18 Jehu gada all di pipol kon tell dem, “King Ahab woship juju small; but Jehu go woship juju well-well. 19 So make una koll all di juju profets sey make dem kom meet mi, plus all dia savants and priests. All of dem must present, bikos I won offa betta sakrifice give di juju. Anybody among dem wey nor gri kom, I go kill-am.” But Jehu dey deceive dem, so dat e go fit kill all of dem wey dey serve juju.
20 Den Jehu orda sey, “Make una go arrange big feast for Baal juju.” So dem kon announce am. 21 Jehu invite all di pipol wey dey serve juju for Israel and all of dem kom di party. Pipol full di juju temple from front go rish back. 22 Jehu orda di pesin wey dey keep di garments, “Make yu give garment to all dis pipol.” So, e bring garment kom for dem.
23 Den Jehu and Rekab pikin, Jehonadab kon go di juju temple. Jehu tell di pipol, “Make una make sure sey nobody wey dey serve God dey here with una; bikos na only doz wey dey serve juju must dey here.” 24 Dem kon go inside, so dat dem go offa sakrifice kon burn ofrin. By dis time, Jehu don pozishon eighty men for outside and e warn dem sey, “If any of dis men wey dey inside eskape, una go pay with una life!”
25 Wen e don offa di sakrifice finish, Jehu kon tell di guards for di palis, “Make una enter inside di temple go kill all of dem and make no one eskape!” Di guards and ofisas kill all of dem for der kon trow dia body for outside, den dem waka enter inside di main room for di juju temple. 26 Dem bring di pila for di juju temple kom outside kon burn dem. 27 Dem break di juju image and en house and na der pipol dey shit put kon rish today.
28 So Jehu stop juju woship for Israel.
Jehu Die
29 But Jehu kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin, wey make Israel sin as dem dey woship di juju wey dey Bethel and Dan.
30 God kon tell Jehu, “Evritin wey I won make yu do to Ahab family, yu don do am. So I promise yu sey yor shidren-shidren go bi king for Israel from naw go rish di fourt generashon.” 31 But Jehu nor obey di Oga, Israel God with en whole heart; instead e kon dey sin like Jeroboam wey make Israel sin.
32 For dat time, God kon dey reduce di land wey Israel pipol get. King Hazael for Siria kollect Israel pipol land 33 from Jordan River east go rish di sout towns for Aroer for River Arnon, plus Ramot and Bashan for where Gad tribe, Reuben tribe and East Manasseh tribe dey stay.
34 Evry oda tin wey Jehu do, plus all en mighty-mighty works, dem rite dem put for Israel kings history book.
35 King Jehu die and dem beri am for Samaria and en son Jehoahaz kon take-ova as king. 36 Jehu rule from Samaria as king for Israel for twenty-eight years.