9
King Jehu For Israel
Naw, Elisha koll one among di profet sons kon sey, “Wear yor klot, den take dis olive oil kontaina go Ramot for Gilead. Wen yu rish der, make yu find Jehu, Jehoshafat pikin and na Nimshi bi Jehoshafat papa, den take Jehu go one room. Take di olive oil, pour am for en head kon sey, ‘Dis na wetin God tok, “I don choose yu as Israel king.” ’ Den make yu kwik-kwik komot from der!”
So di profet pikin kon go Ramot for Gilead. Wen e rish der, Jehu wey bi di sojas oga, sidan for der. So e sey, “Offisa, abeg, I get message for yu.”
Jehu kon ask, “Na wish one of us yu dey tok to?”
E ansa, “Oga, na yu.”
So Jehu stand up, follow am go inside. Den di profet pour di olive oil for en head kon sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I don choose yu as Israel king. Yu go distroy yor oga, Ahab family. I go revensh Jezebel bikos of my savants, di profets wey e kill. Evribody for Ahab family go die finish. Evry son wey dey Ahab family for Israel, I go kill all of dem, both di ones wey dey free and di ones wey bi slave. As I do Jeroboam, Nebat pikin and Baasha, Ahijah pikin with dia shidren-shidren, na so too I go distroy Ahab shidren-shidren. 10 Dogs go chop Jezebel for Jezrel land and nobody go beri am.’ ” Den di yong profet kon kwik-kwik komot der.
11 Wen Jehu go back go meet di oda ofisas, dem kon ask am, “Yu dey okay? Wetin make dis mad man kon visit yu?” Jehu ansa, “E nor dey important! Una know dis pipol with di way dem dey tok.”
12 But dem sey, “Yu dey lie! Make yu tell us wetin e tok.”
Jehu ansa, “E tell mi sey, God tok sey: ‘I don choose yu to bi king for Israel.’ ”
13 So each of dem kwik-kwik remove dia klot kon spread dem put for Jehu leg for di step. Dem blow di trumpet kon shaut sey, “Na Jehu bi king!”
Jehu Kill Joram And Ahazaya
14 Den Jehu kon dey plan against King Joram wey dey Ramot Gilead dey trit ensef from di wound wey e get from di fight against King Hazael for Siria. 15 So Jehu tell di oda ofisas, “If una dey with mi, make una make sure sey nobody komot from Ramot go warn Jezrel pipol.” 16 Den Jehu enter en horse kon go Jezrel, bikos dem dey trit Joram for der. (For dis time, King Ahazaya for Judah don kom visit Joram.)
17 Naw, di gateman stand for di gate for Jezrel kon si Jehu men dey kom. So e sey, “I si some men dey kom!”
King Joram kon orda sey, “Make yu send one pesin go mi dem kon ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”
18 So dem send one man go meet Jehu kon ask, “Di king dey ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”
Jehu ansa, “E nor koncern yu, just follow mi.”
Di gateman kon go tell di king, “I send pesin go, but e neva kom back.”
19 So e send anoda pesin go ask, “Dis na wetin di king ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”
Jehu ansa dis one too sey, “E nor koncern yu, just follow mi.”
20 Di gateman kon go tell di king again sey, “I send anoda pesin go, but e neva kom back. But di pesin wey dey lead dis men bi like Jehu and e dey ride kom with speed.”
21 King Joram kon sey, “Make una ready my horse.” Wen dem don ready en horse, King Joram for Israel and King Ahazaya for Judah kon enter dia horse go meet Jehu. Dem meet am for one land wey bi Nabot for Jezrel own before. 22 Wen King Joram si Jehu, e kon ask, “Jehu, hope evritin dey okay?”
Jehu ansa, “How evritin won take dey okay wen yor mama still dey make pipol serve juju and do oda bad tins.”
23 King Joram kon tell King Ahazaya sey, “Na plan work!” Den e turn en horse kon dey run. 24 Jehu karry en bow and arrow kon shot King Joram and di arrow enter en heart, so e fall from en horse kon die. 25 Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey, 26 ‘I si as una kill Nabot and en sons yestiday. And I promise sey I go still ponish yu for dis same land.’ So make una trow di body for di field, so dat wetin God tok, go happen.”
27 Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die. 28 En offisa karry en body go back to Jerusalem kon beri am with en grand-grand papa dem for David Town. 29 Ahazaya na king for Judah for eleven years wen Joram, Ahab pikin dey rule.
30 Jehu kon ride dey go Jezrel. Wen Jezebel hear wetin happen, e paint en eye, do en hair well kon dey look from di window. 31 As Jehu enter thru di gate, Jezebel kon sey, “Zimri, yu wey kill yor oga! Hope evritin dey okay? Wetin yu dey do for here?”
32 Jehu look up kon shaut, “Na who dey my side?” Like two or three kourt ofisas look am from di window. 33 So Jehu orda, “Make una trow dat woman kom down!” So dem trow Jezebel from di window kom down. And as Jezebel nak groun, en blood kon spread go di wall and di horse body, den Jehu ride en horse pass Jezebel dead body.
34 Jehu enter di palis kon sidan chop for der. Den e sey, “Make una go trowey dis wiked woman dead body. Make una beri am, bikos na king pikin e bi.” 35 But wen dem won go beri Jezebel, dem nor si anytin escept en skull, leg and hand. 36 Dem kon go back go tell Jehu wetin happen, den e sey, “All wetin God tok thru en savant Elijah wey kom from Tishbe, don really happen. Bikos Elijah warn dem sey, ‘Na for Jezrel land, dogs go for chop Jezebel flesh kon lick en blood. 37 Wetin remain for Jezebel body, go skata like dirty for Jezrel land and pipol nor go fit know am at-all.’ ”