11
Atalaya Rule Judah
Wen Atalaya, Ahazaya mama si sey en pikin don die, e kon kill evribody for di king family. So King Joram dota, Jehosheba, wey bi Ahazaya sista, eskape with Ahazaya pikin, so dem nor kill-am with di oda king shidren. Jehosheba keep di boy with en nurse for one room where dem dey keep tins inside di temple, so dat Atalaya nor go fit si and kill-am. Di boy dey inside God temple for six years, wen Atalaya dey rule.
Den for di sevent year, Jehoiada wey bi di priest kon send message sey make dem koll di sojas and di guards oga kom meet am for di temple, where e for make kovenant and swear with dem. Den e show dem di king pikin kon kommand dem sey, “Dis na wetin una go do. Una wey dey kom work for Sabat Day, make una divide unasef into three group. One part go dey protet di king palis, anoda part go dey for di Sur Gate and di last part go dey di gate wey dey di guards back. Una go choose as una go take dey kom guide di palis. Di remainin two part wey nor dey work for Sabat Day, go dey protet God Temple. Una must always dey guide di king with una bow, arrow and spear. And make una kill anybody wey waka anyhow kom di aria where di king dey. Wen ever di king dey do anytin, una must dey with am.”
So di sojas oga kon do evritin, just as Jehoiada kommand dem. E bring all en men kom, both doz wey dey work for Sabat Day and doz wey nor dey work. 10 Jehoiada kon give di sojas oga, King David spear and shield wey dey God Temple. 11 Di guide hold dia swod, bow, arrow and spear as dem dey guide di temple where di king dey; dem dey guide evriwhere from rite to left and from di altar go rish di temple.
12 Jehoiada bring di king pikin kom out kon crown and gi-am God laws. Den dem make am king, anoint am kon klap dey sey, “God save di king!”
13 Wen Atalaya hear di royal guide dey shaut, e kon go meet di pipol for God Temple. 14 Den Atalaya look well kon si di king stand near di pila akordin to dia tradishon. Doz wey dey kommand and blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land dey happy kon dey blow trumpet. Atalaya tear en klot kon sey, “Dis na plan work! Una really plan dis one o-o!”
15 Den Jehoiada kon tell di sojas, “Make una karry Atalaya go meet di guards for outside. Make una kill anybody wey won stop una.” Di priest give dis orda, so dat dem nor go kill Atalaya inside di Temple. 16 Dem hold and drag Atalaya pass where horse dey for di king palis kon kill-am for der.
17 Den Jehoiada with di king and di pipol kon make kovenant sey, na only God dem go always dey serve. 18 Di pipol kon go skata dia juju, di juju house dem and en altar. Dem kill Mattan wey bi di juju priest for di altar front.
Jehoiada kon put guards for di Temple. 19 So, en, di sojas oga, di guards oga and di pipol kon take di king from di Temple go di palis thru di royal bodyguard gate, den di king kon sidan for di throne. 20 Evribody for di land bigin happy, bikos peace kon dey di land afta dem kill Atalaya for di royal palis.
Jehoash Rule Judah
21 Jehoash na seven years wen e stay to rule.