20
Hezekaya Sickness
For dat time, King Hezekaya kon dey sick and e nearly die. Amos pikin, Profet Isaya go si am kon sey, “God sey make yu arrange evritin as dem suppose dey, bikos yu nor go well again. Make yu ready to die.”
So Hezekaya turn face wall kon pray sey: “My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.
Isaya waka leave di king, but before e pass di kourtyard centre for di palis, God kon tell am, “Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple. I go let yu leave for anoda fifteen years. I go save yu and dis town, Jerusalem from Assyria king hand. Bikos of my honor and di promise wey I make with my savant David, I go defend dis town.’ ”
Den Isaya sey, “Make una skwiz some fig for mi.” So dem do as e orda dem and e put am for di king sore make en body for well.
King Hezekaya tell Isaya, “Wetin I go take know sey God go heal mi, so dat I go-go en Temple by dis time next tumoro?”
Isaya ansa, “Dis na di sign from God to show sey E go do wetin E tok. Yu go wont make di shadow for wall move go front ten times, abi make e go back ten times?”
10 Hezekaya ansa, “E dey eazy for di shadow to move go front, but e nor eazy to go back ten times.”
11 So, Profet Isaya pray to God and God make di shadow go back ten times for Ahaz wall.
Messenja From Babilon
12 For dat time, Baladan pikin, King Merodak-Baladan for Babilon send leta and gift go give King Hezekaya, bikos e hear sey Hezekaya dey sick. 13 King Hezekaya welkom di pipol wey dem send kom kon show dem evritin wey dey en palis, di silva, gold, spices and di betta olive oil, plus all di war tins and fine propaty. E nor get anytin for di palis and di whole kingdom wey King Hezekaya nor show dem.
14 Den Profet Isaya visit King Hezekaya kon ask, “Wetin dis men si? Where dem from kom?”
Hezekaya ansa, “Dem kom from Babilon.”
15 Profet Isaya ask, “Na wetin dem don si for yor palis?”
Hezekaya ansa, “Dem don si evritin for my palis. I show dem evritin wey wi get.”
16 Isaya kon tell King Hezekaya sey, “Make yu listin to God word, 17 ‘Si, evritin for yor palis, plus all di tins wey yor grand-grand papa dem don gada rish today, dem go pak all of dem one day karry go Babilon; nor-tin go remain.’ God still sey, 18 ‘Dem go karry some of yor own shidren go Babilon go bi priest for di king palis.’ ”
19 Hezekaya kon tell Isaya, “God word wey yu tok so, dey korrect.” Den e sey, “At least dis tins nor go happen for my own time.”
20 Di remainin tins wey Hezekaya do, plus all wetin e get and how e build pool where wota go from dey kom di town, dem rite am put for Judah kings history book. 21 Hezekaya kon die and en pikin Manasseh kon take-ova as king.