21
Manasseh Rule Judah
Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-five years. En mama name na Hepzibah. E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der. E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky. E build juju altar for God Temple, even wen God don sey, “Jerusalem na my house.” For di two kourtyard wey dey God Temple, e build altar for all di stars wey dey di sky. E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.
E put Asherah juju wey e make for di temple, di place where God don tell David and en pikin, Solomon sey, “Dis temple for Jerusalem wey I don choose from all di tribes for Israel, go bi where I go stay forever. I nor go porshu Israel pipol from dis land wey I don give to dia grand-grand papa, as long as dem obey all di kommand and laws wey I give dem thru Moses, my savant.” But dem nor gri obey and Manasseh make all of dem bigin sin pass di kountries wey God distroy bikos of Israel pipol.
10 So God kon tok thru en savant di profet sey: 11 “King Manasseh for Judah don sin well-well, E don sin pass Amor pipol wey dey here before and e don enkourage Judah pipol to sin as dem dey serve all dis yeye juju. 12 So dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok, ‘I go kause wahala for Jerusalem and Judah pipol. And e go shok anybody wey go hear wetin happen. 13 As I take distroy Samaria and Ahab generashon, na so too I go distroy Jerusalem. I go make sure sey nor-tin dey for Jerusalem again and e go bi like plate wey dem wosh klean. 14 Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty, 15 bikos dem don sin against mi kon make mi dey vex since wen dia grand-grand papa komot from Egypt kon rish naw!’ ”
16 Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
17 Di remainin tins wey Manasseh do, plus all wetin e get and di sins wey e kommit, dem rite dem put for Judah kings history book. 18 Manasseh die and dem beri am for Uzza gardin wey dey en palis and en pikin, Amon kon take-ova as king.
Amon Rule Judah
19 Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for two years. En mama name na Meshullemet and na Haruz wey kom from Jotbah, born di woman. 20 E nor gri obey God kommand, but e sin like en papa Manasseh. 21 E dey do like en papa, bikos en too dey woship and bow to yeye gods and juju wey en papa woship.
22 E nor gri follow en grand-grand papa dem Oga wey bi God or listin to en kommand. 23 Amon savants kon plan and kill-am for en palis. 24 Di pipol for di land kon kill all doz wey plan kill King Amon, den dem kon make en pikin Josaya, king for Judah.
25 Di remainin tins wey Amon do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book. 26 Dem beri am for en own grave for Uzza gardin and en pikin Josaya kon take-ova as king.