6
Sabat Day Oga God
Jesus dey waka pass where dem plant korn put and en disciples kon plok some korn dey chop. Some of di Farisee pipol kon sey, “Why una dey do wetin awa law tok sey make wi nor do for Sabat Day?”
Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men dey hongry? E enter God house kon take di bread wey holy wey only priests suppose chop and en and en men chop am.” So Jesus tell dem, “Na Man Pikin bi Sabat Day Oga God.”
Jesus Heal Hand Wey Don Die
For anoda Sabat Day, Jesus enter di sinagog dey tish. One man wey en rite hand don die dey der. Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am. But Jesus know wetin dem dey tink, so e kon tell di man wey en hand die, “Get up, make yu kom stand for here”, so di man get up, go stand near am.
Den Jesus ask dem, “E dey rite to do good for Sabat Day” or “to save or distroy anybody life?”
10 Afta Jesus look dem round, e kon tell di man, “Stresh yor hand out.” So di man stresh en hand and di hand kon well. 11 But di Farisee pipol and di law tishas kon vex sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin ask diasef, “Wetin wi go do Jesus Christ.”
Jesus Choose En Twelf Disciples
12 Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break. 13 Wen day break, Jesus koll en disciples kon choose twelf among dem wey e koll apostles: 14 Simon (wey bi Pita) and en broda Andru and James, John, Filip, Bartolomew 15 Matiu, Tomas, James (Afaeus pikin) Simon wey bi Zealot, (pesin wey dey fight for en kountry). 16 Judas (James pikin) and Judas Iskariot wey leta sell Jesus give en enemies.
Jesus Tish And Heal
17 Den Jesus kom down with en apostles kon stand for groun wey level. Many disciples from Judea, Jerusalem and all di small towns wey near Tyre and Sidon gada kon hear am dey prish and e heal doz wey nor well 18 and odas wey evil spirit dey worry. 19 Evribody dey try to tosh am, bikos pawa wey dey komot from en body, dey heal pipol.
20 Den Jesus look en disciples, tell dem,
“Make una happy, una wey dey poor,
bikos na una get God Kingdom.
21 Make una happy, una wey dey hongry,
bikos una go beleful.
Make una happy, una wey dey kry naw,
bikos una go laf.
22 Una wey pipol hate, rijet, curse and dey koll bad pipol
bikos of Man Pikin, God go bless una
23 and una go dey happy for dat day.
“Make una happy well-well, bikos di reward wey una go get for heaven, go big well-well. Na so dia grand-grand papa dem tok about di profets too.
24 “But curse dey una head, una wey get money well-well naw,
bikos una don already get una reward.
25 Curse dey una head, una wey don ova beleful,
bikos una go hongry.
Curse dey una head, una wey dey laf naw,
bikos una go kry well-well.
26 Curse dey una head,
una wey pipol dey tok good tins about,
bikos na so dia grand-grand papa dem tok about
di fake profets too.
27 “But I dey tell una wey dey listin, ‘Make una love una enemy and do good to pipol wey hate una.’ 28 Make una bless doz wey curse una and pray for doz wey dey trit una anyhow. 29 If anybody slap una for face, make una turn di oda side gi-am too. If anybody use force kollect una koat, make una gi-am una shirt join too. 30 Make una give evribody wey ask una for sometin and if anybody take wetin bi una own, make una nor ask for am back. 31 Make una do for pipol as una wont make dem do for una.
32 “If una love only di pipol wey love una, wetin go make God bless una? Even sinnas sef love doz wey love dem. 33 And if una do good for only doz wey dey do good for una, wetin go make God bless una? Even sinnas dey do di same tin too. 34 If una borrow pesin money wen una know sey e go fit pay una back, wetin go make God bless una? Sinnas sef dey borrow money give sinnas, so dat dem go pay dem back dia korrect money. 35 But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu. 36 So, make una dey show mesi, just as una Papa dey show mesi.”
Nor Judge Odas
37 “Make una nor judge oda pipol, so dat God nor go judge una. Make una nor kondemn odas, so dat God nor go kondemn una. Make una forgive odas and God go forgive una. 38 Make una give pipol wey nor get and God go give una wetin really big, E go pak am well-well and di tins go ova full. God go pour all dis tins for una life. But na as una take give odas, na so God go take give una too.”
39 Jesus still tell dem anoda parabol, “Pesin wey blind nor dey fit show anoda blind man road, abi e go fit? No! If na so, dem two go fall inside gutta. 40 No student go fit big pass en tisha, but wen e don learn finish, e go bi like en tisha.
41 “Why yu dey look di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey yor own eye. 42 How yu go take tell yor broda sey, ‘Broda, make I remove di dirty wey dey yor eye, but yu nor dey si di wood wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, make yu first komot di wood for yor eye, den yu go si well to fit remove yor broda own.’
43 “Bikos betta tree nor dey bear bad fruit and know bad tree dey bear good fruit, 44 bikos na fruit wey tree bear, naim pipol dey take know di kind tree wey e bi. Pipol nor dey plok fig or grape from shuku-shuku tree. 45 Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.
46 “Why una dey koll mi, ‘Oga God’ and una nor dey do wetin I tell una? 47 Anybody wey kom meet mi and listin to my word kon do am; I go show una wetin di pesin bi like. 48 E bi like man wey dey build house, wey dig groun kon lay di foundashon on-top strong rock. Wen big wota rush kom, e nor go fit shake di house, bikos dem build am for betta rock. 49 But di pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like man wey build house wey nor get strong foundashon. Wen big wota kom, di house go fall skata.”