6
Di Seven Keys
As I dey look, di Lamb kon open one for di seven keys and I hear one for di for creatures dey shaut like tonda sey, “Make yu kom!” So I look kon si one white horse dey kom! Di pesin wey dey ride am whole bow and e wear crown for en head. E go fight and win many war and na champion e bi.
Wen di Lamb open di sekond key, I kon hear di sekond creature dey sey, “Make yu kom!” Den anoda red horse kom out. Dem give di pesin wey dey ride am, big swod and pawa to take remove peace from dis eart. So pipol kon dey fight and kill each oda for evriwhere.
Den wen di Lamb open di third one, I hear di third creature dey sey, “Make yu kom!” So I look and I si one black horse dey kom! Di pesin wey dey ride am hold ruler for en hand. Den I hear one vois among di for creatures dey sey, “Dem dey sell six pound for barley and one bread for only one penny and make yu nor spoil di olive oil and wine.”
Wen di Lamb open di fourt key, I hear di fourt creature dey sey, “Make yu kom!” So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.
Wen di Lamb open di fift key, pipol wey dem don kill bikos of God word and wetin dem dey tok about Christ, I si dia soul for under di altar. 10 Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!” 11 Den dem give each of dem long white klot kon sey, make una rest small until di oda savants and una brodas for Christ wey wiked pipol go kill, don komplete.
12 Den di Lamb open di sixt key and big eartkweke kon happen. Di sun kon dark like black klot and di moon kon dey red like blood. 13 Di stars for sky fall kom groun like di way fig tree fruit wey ripe, dey fall wen strong breeze dey blow. 14 Di sky kon dey fold like paper and evry mountin and island move komot from where dem dey before. 15 Den evribody, both di kings for di eart; di rulers; ofisas; doz wey get money; doz wey get pawa and evry slave and free pesin kon hide demsef for holes and among di mountins. 16 Dem kon dey kry give di mountin and di rock sey, “Make yu fall on-top us and hide us from di Pesin wey sidan for di throne and make yu hide us from di Lamb vexnashon.” 17 Bikos di day to ponish dem, don kom and nobody go survive am.